Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 19:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 bikos wi kom distroy di town. Dia sin and di wiked tins wey dem dey do, don too many. So God send us kom distroy am.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 19:13
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

wey en pipol wiked and dey sin against God.


Den God tell Abraham, “Di kry against Sodom and Gomorrah too mush and dia sins too many.


So di two angels kon tell Lot, “Yu still get anybody for dis town? Yor pikin husband dem dey di town? Abi yu get any broda or sista for here? Go tell dem make dem komot from dis town,


But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.


Na God kommand make mi kom here won distroy dis kountry so. Na God ensef tell mi sey, ‘Make yu go attack and distroy dis land.’ ”


So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!


Bikos God nor fit bear all di yeye tins wey una dey do, na dis make am turn una land to where pipol dey curse. E don skata am and pipol nor dey stay der again.


I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.


“Make una komot from among dis kommunity, so dat I go distroy dem kwik-kwik.”


At wons God angel kon nak Herod fall for groun, bikos e nor give God glory and plenty worm kon chop en body till e die.


If una nor gri listin to di Oga una God or obey en kommand and law wey E give una, all dis curse go porshu una, until e distroy all of una.


I koll heaven and eart as witness today against una. If una break di kommand wey God give una thru mi, una go die for di land wey una won cross Jordan River enter. Una go stay der small; den God go distroy una finish.


Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.


Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ