Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 18:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 E take some cream, some milk and di meat kon set di food for di men front. For under di tree for der, Abraham kon serve dem by ensef and di men kon chop.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 18:8
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e run go where di animals dey, take one melu wey fine and fat kon give one savant, wey kwik-kwik go kill-am.


Den dem kon ask am, “Where yor wife Sarah?” Abraham ansa, “E dey inside house.”


Lot beg dem well-well, so dem kon enter en house. E kommand en savant make e bake bread without yist for dem and dem kon chop.


Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do.


Na milk and honey e go dey chop and dis food go help am know how to rijet evil and choose wetin dey good.


dem go still produce enough milk for am. Yes! Di few pipol wey go survive go si plenty food chop.


Di savant wey en oga go kom back kon meet am dey work, make e happy well-well bikos di oga go prepare ensef make e for serve di savant food for tabol.


No! Instead una go tell am, ‘Prepare my evening food and serve mi, make I chop and drink. Wen I don finish, yu fit go chop yor own.’


E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem.


So dem kon do party for Jesus dat evening. Marta kon dey serve dem food and Lazarus dey among di pipol wey sidan for tabol with Jesus.


Nor bi evribody si am, but na di ones wey God don choose, wey follow am chop and drink afta e don wake-up from deat.


My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.


E feed dem with milk from di animals and with di fats wey dey lamb body. E give dem betta ram and goat form Bashan, plus fine-fine food. Una don drink di wine wey sweet pass wey dem make from grape.


Listin! I stand for di door dey nok! If anybody hear my vois, kon open di door, I go enter go meet am, kon follow am chop and e go chop with mi too.


Den Manoah tell God angel, “Abeg stay here make wi kill and kook one small goat make yu chop.”


Sisera ask am for wota, but e gi-am milk. E use fine bowl take bring di milk for am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ