wot of if na five nor make am rish fifty? Yu go distroy di town, bikos five nor make am rish fifty?” Oga God ansa, “I nor go distroy di town if I si forty-five pipol for der wey dey fear mi.”
Den Abraham sey, “God, make Yu nor vex o-o, bikos I still won tok! Wot of if dem bi thirty for der.” God ansa, “I nor go do am if I si thirty for der.”
With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.