Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 18:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Bikos Sarah dey fear, e kon deny sey, “Na lie! I nor laf.” But di Oga God kon sey, “No! Yu laf.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 18:15
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So make yu tell dem sey, yu bi my sista, so dat dem nor go kill mi.”


E get anytin wey too hard for God to do? As I tok before, nine monts from naw I go kom back and Sarah go born boy.”


Wen di men stand up won go, dem kon go where dem go for fit si Sodom well-well and Abraham escort dem go.


Den Oga God ask Kain, “Where yor broda dey?” Kain ansa, “I nor know! Na mi dey keep my broda?”


But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.


E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.


Yet bikos of am, dem dey kill us evriday; dey trit us like sheep wey dem won kill.


Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.


Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi.


At wons, Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, so e kon ask dem, “Why una dey tink like dis?


Di girl wey dey di gate kon ask Pita, “Yu nor bi one of dis man disciple?” At wons, Pita ansa, “I nor bi one of dem.”


E nor nid anybody to tok about am, bikos e know wetin dey inside pipol belle, so e nor fit trust dem.


Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.


and make una dey tink betta tins for una mind.


Since una don kill una old sef and di tins wey una dey do before, make una nor dey lie give each oda.


If wi sey wi nor get sin, wi dey deceive awasef and di trut nor dey inside us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ