Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 17:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Abram bow face groun and God tok to am,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 17:3
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?”


Abraham look and e si three men stand for di oda side. Wen e si dem, e run go meet dem kon bow for dem.


Wen di pipol si dis tin, dem fall face groun kon dey sey, “Na God bi di true God! Na God bi di true God!”


E still tell am, “Na mi bi yor papa Abraham, Isaak and Jakob God.” Den Moses hide, bikos e dey fear to look God face.


Di lite wey dey shine round am bi like rainbow afta rain don fall. Dis na di lite wey dey show how God glory bi. Wen I si am, I fall face groun and I kon hear somebody dey tok.


So I go di valley and for der, I si God glory, just as I si am near Chebar River. So I fall face groun


Na only mi dey der wen dem start to kill. So I fall face groun kon shaut, “Oga God wey get pawa well-well, na so Yu dey vex for Jerusalem? Yu wont kill evribody wey dey Israel?”


But I hear as e dey tok and wen I hear dis vois, I just fall face groun.


Den Moses and Aaron fall face groun for di pipol front.


Den dem fall face groun kon sey, “My God, di God of all pipol spirit, Yu go vex for di whole kommunity wen e bi sey na only one pesin sin?”


“Make yu komot from dis kommunity, so dat I go distroy dem naw-naw!” Moses and Aaron kon bow face groun.


Wen di disciples hear di vois, dem fear kon fall face groun.


Di man ansa, “Na mi bi di oga among God sojas for heaven. Naw I don kom!” Joshua fall face groun kon sey, “Wetin my oga won tell en savant?”


Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,


As di smoke dey go up for di altar, Manoah and en wife kon si God angel inside di smoke dey go heaven, so dem kon fall face groun.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ