15 God tell Abraham, “Make yu nor koll yor wife Sarai again; from naw go, en name na Sarah.
Abram and Nahor kon marry wife. Abram wife name na Sarai and Nahor wife name na Milka wey bi Haran pikin and Haran na still Iskah papa too.
Anybody wey dem neva sekonsaiz, I nor go koll am my own, bikos e neva keep di kovenant with mi.”
I go bless am and I go make am born boy for yu. I go bless am and Sarah go bi plenty pipol mama and kings go dey among en shidren-shidren.”
Yor name nor go bi Abram again, but e go bi Abraham, bikos I dey make yu papa for many nashons.
Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
and E kommand Profet Natan make e koll am Jedidaya, bikos God love am.
God sey, “Una wey wont make dem save una; una wey dey kom meet mi make I help una. Make una tink of di Rock wey una from kom, di place where dem from kut una from.