Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 17:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Una must sekonsaiz evry pikin and dis go bi sign to show sey my kovenant with yu, go bi forever.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 17:13
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Abram hear sey dem dey karry en broda pikin go as slave, e kon koll en three hundred and eighteen men wey dem train well and dem born dis men for en house, den dem kon porshu di four kings go rish Dan.


Abram still sey, “Since Yu neva give mi shidren, den one of my savants go inherit my propaty!”


“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.


So make wi sell am give dis Ishmael pipol, but make wi nor kill-am, bikos e still bi awa broda; awa flesh and blood.” En brodas kon agri with wetin e tok.


Naw, Midian pipol kon sell Josef for Egypt to Potifa, wey bi offisa to Fero and naim dey kaptain di guide dem.


Naw, dem kon take Josef kom Egypt and Potifa, one Fero offisa and di bodyguard oga for Egypt kon buy Josef from Ishmael pipol wey bring am kom der.


Wen di rainbow dey for di kloud, I go si am kon remember di everlastin kovenant between mi and evritin wey get life for dis eart.”


Wi bi Jew pipol too, awa shidren bi like dia own shidren. But wi sell awa shidren as slave give dem. Dem don sell some among awa dotas as slave. Wi nor get pawa or who go help us, bikos dem don take awa farms and vineyards from us.”


I kon sey, “Just as wi fit, wi don dey buy awa Jew brodas wey sell demsef give strenjas back. But naw, una by unasef won sell una own brodas! So how many times wey go buy dem back?” But di leaders kwayet and nor fit defend diasef.


But any slave wey yu buy wey dem sekonsaiz, fit chop am.


“Anybody wey kidnap and sell pesin or dem katch di pesin for en hand, dem must kill-am.


“If una buy any Hibru slave, e go serve una for six years, but e go dey free for di sevent year and e nor go pay anytin.


“If na en oga gi-am wife and en wife born shidren, den na en oga go get di wife and di shidren, so na only di slave go-go.


But di priest slave wey e buy or wey dem born for en house go fit chop di food wey dem give di priest.


Bikos e nor fit pay wetin e whole, di king kon orda make dem sell di man, en wife, en shidren and evritin wey e get, take pay di debt.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ