But en wife Zipporah kut en son skin with knife kon take am tosh Moses leg, den e sey, “True-true, I don take yu from deat hand and yu bi my husband wey I marry with blood.”
Make una keep di kovenant wey una make with mi wey bi una God kon dedikate unasef to mi. If una nor do am and una kontinue di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire. E go burn well-well and nobody go fit kwensh am.”
So God make kovenant with Abraham thru sekonsishon. Abraham kon born Isaak and sekonsaiz am afta eight days. Isaak born Jakob and Jakob born di twelf brodas, wey bi awa grand-grand papa dem.
Na God give us Jesus Christ, so dat thru en blood, E go forgive us awa sins wen wi bilive Christ. God do dis to show sey before-before, E dey patient to forgive pipol dia sins.
Make una remember sey before-before una bi Gentile pipol wey dey do wetin di flesh wont and Jew pipol dey koll una, “pipol wey dem neva sekonsaiz” like di way dem dey sekonsaiz human being.
Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.