9 Den di angel tell am, “Go back go meet yor madam make yu respet am.
I go make yor shidren-shidren great.” God angel still sey, “Dem go plenty well-well and nobody go fit kount dem.”
Abram ansa Sarai, “Since yor savant dey under yor pawa, make yu do am anytin wey yu like.” Den Sarai kon dey ponish Hagar, so Hagar kon run leave Sarai.
Di angel tell am, “Hagar, Sarai savant, where yu from kom and where yu dey go?” Hagar ansa, “I dey run from my madam, Sarai.”
If yor oga dey vex for yu, make yu nor vex stop di work wey yu dey do, bikos gentol spirit dey korrect big mistake.
Bikos of di respet wey una get for Christ, make una dey respet one anoda.
Una wey bi savant, make una dey do evritin wey una oga wont and wen una oga tok to una, make una nor dey ansa am anyhow.