12 Yor pikin go live like donkey wey wiked well-well; e go dey against evribody and evribody go dey against am. E nor go stay with en family.”
God dey with di boy as e dey grow. E stay for di wildaness kon turn to who dey shot bow and arrow.
E shidren-shidren kon stay for Havilah go rish Shur wey pass Egypt go rish Asshur. Dem nor stay near dia relashon at-all.
Na so-so swod yu go take dey fight and yu go serve yor broda. But wen e don taya yu, den yu go free yorsef from all dis tins.”
Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.
Pesin wey nor get sense, nor go fit wise unless donkey go fit born human being.
Just like wiked donkey for desert, na so poor pipol dey find food waka. Dem even dey find food rish desert so dat dia shidren go chop.