My heart dey kry for Moab pipol, bikos di pipol don run go Zoar, Eglat and Shelishiyah town. Some even dey kry as dem dey go Luhit, while odas eskape go Horonaim town.
“ ‘Wen dem don santify am finish, weda na boy or girl e born, e go-go di tent wey dem for dey meet go give di priest one lamb wey bi one year for burnt ofrin and one pijin or dove for sin ofrin.
“ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”
den dem go take one melu and ram for peace ofrin. Dem go sakrifice dem give God with di korn ofrin wey dem mix with olive oil. Dem must do am, bikos God go appear to dem today.’ ”