For di fourteent year, Kedorlaoma and di kings wey join togeda kon go win Refah pipol for Ashterot-Karnaim, Zuz pipol for Ham, Emite pipol for Shaveh Kiriataim
Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”
Joshua ansa dem, “If una many well-well and di kountries for hill too small for una, den make una go inside di forest kon klear Periz and Refah land for unasef.”