Oga wey bi di God for heaven wey take mi komot from my papa house and di land wey my pipol dey, naim promise mi wen E promise sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ So God go send en angel go for yor front, so dat yu go si one good wife for der kon bring kom give my pikin.
I go make yor shidren plenty like di stars wey dey di sky and I go give dem all dis land. I go bless all di nashon for di world with yor shidren-shidren name.
E go give yu and yor shidren-shidren di blessing wey E give Abraham, so dat una go take di land wey God give Abraham; di land wey yu just dey stay as strenjas.”
Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”
Na so God go take bless my shidren-shidren, bikos E don make kovenant wey go last forever with mi: agriment wey nor dey break and promise wey nor dey shange. Na wetin go give mi viktory bi dat and God go make am happen.
For dat time, Solomon and Israel pipol celebrate for seven days. Pipol from Hamat for nort go rish Egypt wotaside for sout, still dey join dis pipol too.
Na bikos Yu si as e dey faithful rish, naim make Yu make kovenant with am. Yu promise to gi-am Kanaan, Hit, Amor, Periz, Jebus and Girgash pipol land. Di land wey en shidren-shidren go stay and Yu keep yor promise, bikos Yu dey faithful.
I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
Make Yu remember Abraham, Isaak and Israel yor savants wey Yu promise sey, ‘I go make una shidren-shidren plenty like di stars for sky and all dis land wey I don tok about, I go give dem to una shidren-shidren and dem go stay der forever.’ ”
Bikos una dey kom meet mi di Oga una God three times evry year, I go drive di pipol for doz kountry wey won stop una and I go make una land big; so dat nobody go fit take una land.
Di time dey kom wen God go shake di tree from Eufrates River go rish di rut for Egypt and just as farmer dey separate korn from dia kanda, na so too God go gada and separate en pipol one-by-one.
My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.
I go renew di kovenant wey I make with dia papa wen I show all di kountries my pawa wey I take karry dem komot from Egypt, so dat mi wey bi di Oga God, go bi dia God.”
Dat time, God neva gi-am any part for di land and e neva born any pikin, but God promise am sey E go gi-am di land and en and en shidren go stay der forever.
Anywhere wey una waka rish, dat land go bi una own. Una land go long and wide from di wildaness go Lebanon and from River Eufrates go rish Mediterranean Sea.
Den God tell Moses, “Dis na di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob wen I sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ I don let yu si am, but yu nor go cross enter.”
Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)
from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land