Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 15:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Wen evening rish and day don dark, one pot wey dey bring smoke with fire and dey shine like tosh kon pass between di animals wey Abram sakrifice.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 15:17
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Abram take all of dem go gi-am kon kut dem into two, den e put di two side face each oda, but e nor kut di birds.


Smoke dey kom out from en nose, while fire and shako dey kom out from en mout.


At wons, fire from God kon fall from heaven. Di fire burn di ofrin, di wood, di stones and di dirty kon dry di wota wey dey di gutta.


E build altar for der for God kon do burnt and fellowship ofrin for di altar. E pray and God kon ansa am, bikos E send fire from heaven kon burn di sakrifice for di altar.


Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.


Den di pipol si di tonda and di lite. Dem hear di horn sound kon si di mountin wey smoke kover and wen di pipol si all dis tins, fear katch dem, so dem kon waka far from di place.


I nor go rest bikos of Zion and bikos of Jerusalem I nor go kwayet until en raitiousness go shine kom out like morning lite and en salvashon like tosh wey dey shine well-well.


Wen I take Israel, my pipol komot from Egypt where di land bi like fire for dia body, na der I for make kovenant with dem. I tell dem make dem obey and do evritin wey I kommand. I still sey, if dem obey mi, dem go bi my pipol and I go bi dia God.


Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.


As di smoke dey go up for di altar, Manoah and en wife kon si God angel inside di smoke dey go heaven, so dem kon fall face groun.


God angel tosh di meat and bread with di stik wey e hold and fire kom out from di rock kon burn di food finish. Den di angel disappear.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ