24 I nor go take anytin escept di food wey my men chop and di tins wey dem use. But make my men, Aner, Eshkol and Mamre take dia share.”
One pesin kon run go tell Abram wey bi Hibru. For dis time, Abram dey stay near Mamre wey bi Amor pipol oak. Dis Mamre na Eshkol and Aner broda. (All dis group don join Abram.)
doz wey get heart kon go take Saul and en shidren body go beri for Jabesh. Dem beri dem under one oak tree kon fast for seven days.
Anytime wey yu fit, make yu do good to pipol wey nid am.
Bikos of dis, make yu trit pipol as yu wont make dem trit yu, bikos na so dem rite am for di Profets and Moses Law.
Bikos God word sey, “Animal wey dey harvest korn, make una nor tie en mout.” Anybody wey dey work, suppose get en pay.