Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 13:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Dis na di place where e for first build altar. So Abram kon woship God for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 13:4
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Abram karry en tent kon go stay near Mamre oak wey dey Hebron and e build anoda altar for God for der.


Den Isaak build one altar for der kon woship God. E put en tent for der and en savant kon dig anoda well.


Seth too kon born boy and en name na Enosh. From dat time, pipol kon start to woship Oga God.


Make wi tank God, bikos E dey good! En love wey nor dey fail, dey forever.


So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem,


So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem.


So I go tank God with sakrifice kon pray to am.


E dey listin to mi, so as long as I dey alive, I go dey pray to am to help mi,


God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.


Oga God, I love yor temple; di place where Yu dey and where yor glory for dey shine.


Only one day for yor house betta pass one tazon years for anoda place! E betta make I bi gateman for God house dan to dey enjoy life for wiked pipol house.


Wen una pray, I go ansa una. Wen una koll mi, I go hear una. If una stop to opress pipol and tok wiked words kon stop wiked tins;


Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una.


Make una know sey, for dat time, I go make di nashons praiz mi well-well. All of dem go dey pray with my name kon woship mi with one spirit.


To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ