Lot look well-well from Jordan River aria go rish Zoar. E kon know sey evriwhere for der get betta green plant and dem get betta wota like Oga God gardin for Egypt. (Dis na before God distroy Sodom and Gomorrah.)
Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.
Make una look round kon si wetin dey happen! Make all una sons gada kom meet una! Naw God dey sey, as long as una shidren dey alive, dem go bi like pomade for una body; una go wear dem like di gown wey woman wey won marry dey wear.
Make una look round kon si wetin dey happen; una pipol dey gada kom house! Una shidren go kom from far place; dem go karry una girls for shoulder kom back.
Den Moses komot from Moab Wildaness kon go Mount Nebo until e rish on-top Pisgah mountin, opposite Jeriko. God show am all di land from Gilead go rish Dan,