Den God sey, “Make wi kreate human being like Awasef, just as wi bi, so dat dem go bi oga ova di fish dem for sea and di birds for di sky, plus di kattles and ova di whole eart plus evritin wey dey inside.”
So God sey, “Naw wen man don bi like us, wen e don know wetin dey good and bad, make wi nor let am chop from di tree wey dey give life, if not, e nor go ever die.”
God sey, “Israel pipol, make una listin! I dey bring enemies kom from far kountry kon attack una. Na kountry wey strong well-well; wey I kreate since; kountry wey una nor know or undastand dia language.
So if di whole church bigin tok with difren-difren language, den some pipol wey bi unbilivers or doz wey nor undastand kon waka enter di church, dem nor go tink sey all of una don dey kraze?