7 Kush shidren na Seba, Havilah, Sabtah, Rama and Sabteka. Rama shidren na Sheba and Dedan.
Kush na Nimrod papa, dis Nimrod kom bi warrior for di eart.
Di first river name na Pishon; e dey flow for Havilah land, di place where gold dey.
Wen di kween for Sheba hear about di wonderful tins wey Solomon dey do, e kon travel go Jerusalem go test am with hard-hard kweshon.
Kush shidren na: Seba, Havilah, Sabteka, Rama and Sabtah. Rama shidren na: Sheba and Dedan.
den at wons, Sabean pipol just kom attack and karry all of dem go. Dem kill all di savant and na only mi one eskape kom tell yu.”
Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.
Dis message na about Arabia pipol. Dedan pipol wey dey stay for karavan for di empty kountry for Arabia.
Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God. Israel pipol God wey dey holy, wey save una. I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol, so dat una go dey free.
Rhodes pipol dey buy and sell with una; many pipol wey dey stay near sea dey give una ivory and eboni wood, so dat una go give dem some of wetin una get.
Dedan pipol dey give una klot wey dem dey put on-top horse, so dat una go give dem una goods.
Bikos of di tins wey una get, Sheba and Rama pipol dey give una jewels, gold and di spice wey fine pass.