Eber born two pikin: one name na Peleg (wey mean divide), bikos e born am for di time wen God take divide and make pipol dey speak difren language for di world. Di oda pikin name na Joktan.
Wen di God of all ogas give di nashons dia propaty; wen E divide evry human being, E give di pipol where dem go stay rish, akordin to di nomba wey dey for heaven.