kon gada go fight, Bera wey bi Sodom king, Birsha wey bi Gomorrah king, Shinab wey bi Admah king, Shemeba wey bi Zeboiim king and Bela king (di place wey dem also dey koll Zoar).
Sidon pipol, make shame katch una, bikos sea and ocean don rijet una kon dey sey, “Wi neva feel pain like woman wey won born or sey wi don born pikin before; wi neva even train shidren before.”
Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.
Wen di God of all ogas give di nashons dia propaty; wen E divide evry human being, E give di pipol where dem go stay rish, akordin to di nomba wey dey for heaven.
Dem go kamp for di land kon distroy all dia plants from di aria for sout go rish Gaza. Dem go karry all di animals and dem nor go leave anytin make Israel pipol chop.
anoda group face di road wey go Bet-Horon and di last group kon dey waka go di road wey go di borda where dem for dey si Zeboim Valley for di desert side.