Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
Make yu help us beg God, so dat E go kom save us, bikos King Nebukadnezzar for Babilon dey kom attack us. May bi God go do en mirakle, just as E do before kon stop King Nebukadnezzar, so dat e nor go kom attack us again.
God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.
Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?
Jerusalem pipol, make una shaut and kry like woman wey won born, bikos dem must karry una go Babilon as slave. But God go save una for der; E go save una from una enemies hand.