Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 1:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 God sey, “Make di wota divide into two, so dat space go dey di middle.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 1:6
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “Make lite dey for di sky wey go separate di day from di nite and make sign dey wey go show sizin, days, years


Den God kon sey, “Make difren animals wey get life full di wota and make birds full di sky.”


Wen E breath, di sky dey klear. Na en hand E take distroy di big snake.


E load di kloud with wota and lite dey flash kom out


yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong like iron wey dem polish?


Yor dress dey shine like lite and Yu stresh di sky like curtain for heaven;


Make di sky, praiz am! Make all di wota wey dey di kloud for up, praiz am!


Make wi Praiz God! Make wi praiz am for en temple; make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!


Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.


Dem dey show am evriday and for evry nite, dem dey show en greatness.


Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.


Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.


If wota full di kloud, den rain must surely fall for di eart and weda tree fall go nort or sout, di tree must stay for where e fall put.


Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


God make di eart with en pawa; na en wisdom E take kreate di world kon spread di heavens with en sense.


Dis na God message about Israel. Na God kreate di sky and di eart kon give life to man. God sey,


Dem don forget sey, na with word God take kreate di heaven before E kreate di eart from wota and na with wota, E take make dis world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ