30 Plus all di animals for di eart; birds for di sky and evritin wey dey waka for groun. Evritin wey dey alive and evry green plant, I gi-am to una as food.” And na so e kon bi.
And yu go take and gada evry kind food enter inside di boat, so dat una go dey si food chop.”
Una fit chop anytin wey still dey waka. As I give una di green plant, na so too I don give una evritin.
Eagle dey gada round dead body, while small eagle dey drink dia blood.”
For inside forest dia pikin dey grow dey strong and wen dem waka go dia own, dem nor dey kom back again.
Na for mountin dem for dey si food chop, na der dem for dey si green leaf chop.
Si Behemot; I make am di way I make yu, e dey chop grass like melu,
Grass wey dem go chop, dey grow for di hill wey bush animals dey for play.
Yu dey make grass grow for animals to chop kon provide plant for human being to use. Yu allow us produce food from di eart;
E dey give food to wild animals kon feed di yong birds wen dem dey kry.