God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am.
Dem enter with evry kind tin wey get life; difren animal; evritin wey dey creep for groun akordin to how dem bi and evry bird akordin to how dem bi, plus evritin wey get feada.
Make all di tins wey get life kom out with yu. Make evritin kom out: di birds, animals and evritin wey dey creep for groun. Make dem get belle kon born full di eart!”
Evritin wey I kreate for dis eart go dey fear una, both animals and birds for sky. Evritin wey dey creep for groun and di fish for inside sea, go dey under una pawa.
Frog go full River Nile and dem go still dey inside una house, bedroom, on-top una bed, inside una savants and una pipol house; una pots and di kontaina wey una take dey fetch wota.
“Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu: “ ‘Yu bi lion among di nashons, but na ordinary animal yu bi for sea; Yu dey skata di wota with yor leg kon make di river dirty.