Plus all di animals for di eart; birds for di sky and evritin wey dey waka for groun. Evritin wey dey alive and evry green plant, I gi-am to una as food.” And na so e kon bi.
God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am.
And evritin wey get life for di eart kon die: di bird for sky, animals, both di ones for house and wiked ones; evritin wey dey di eart and all human being.
Make all di tins wey get life kom out with yu. Make evritin kom out: di birds, animals and evritin wey dey creep for groun. Make dem get belle kon born full di eart!”
E rite about trees and plants, like di cedar wey dey Lebanon and di plant wey dey grow for wall. E still rite about animals, birds, animals wey dey creep and fish.
Some pipol work with wisdom; with wetin dem know and with dia skill; but dem go still die leave evritin for anoda pesin wey nor work at-all. Dis tins dey yuzles and nor dey good at-all.