18 and dem go dey rule both for day and nite. Dem go separate lite from darkness. So God si sey evritin dey good.
And dat evening and morning kon make am di fourt day.
Di sun dey kom out from one end for di heavens till e rish di oda end and nor-tin fit hide from en heat.
God don promise Israel pipol sey, “E go give dem sun as lite for day time, while di moon and star go dey shine for nite. E sey, E go shake di sea and di wave go roll on-top each oda. En name na God wey dey mighty.”