“As long as di eart dey, time go dey to plant and time go dey to plok wetin dem plant. Sometaims kold go dey and oda times heat go dey. Rain go fall sometaims and oda times evriwhere go dry, but day and nite go always dey.”
Make una look di sky! Who make di stars wey una dey si? Na-im dey lead dem like sojas. E know how dem plenty rish and E dey koll all of dem by dia name! En pawa big well-well and no one among di stars dey miss.
God don promise Israel pipol sey, “E go give dem sun as lite for day time, while di moon and star go dey shine for nite. E sey, E go shake di sea and di wave go roll on-top each oda. En name na God wey dey mighty.”
God wey get pawa sey, “For di six days for di week wen una take dey work, make dem dey always klose di east gate wey dem dey pass enter di kourtyard, but make dem open am for Sabat Day and for di New Moon Festival.
But e get one Pesin wey make di stars, Pleiades and Orion. E turn darkness to lite kon turn day to nite. E koll wota from sea kon pour am put for di eart. En name na God.
Wen una look di sky kon si di sun, moon and stars and as evritin bi for heaven, make una nor let anytin move una to woship or serve dem, bikos di Oga una God don give dem to di pipol for di eart.
Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.