Hezekaya pray to God kon sey: “Oga wey bi Israel God, na Yu bi king among di creatures wey get feadas! Na only Yu bi God ova all di kingdoms for dis eart. Na Yu make di sky and di eart.
Na only Yu bi God. Na Yu kreate di heaven and di stars for sky. Yu kreate land, sea and evritin wey dey inside, den kon give dem life. All di pawa for heaven, dey bow woship Yu.
Bikos na six days God take make heaven, eart and all di tins wey dey inside dem and E rest for di sevent day. So God bless di Sabat Day kon make am holy.
“Israel God wey get pawa; di Pesin wey sidan for where high pass di creatures wey get feadas. Na only Yu bi God wey dey rule all di kingdoms for dis world. Na Yu kreate di eart and di sky.
Make una look di sky! Who make di stars wey una dey si? Na-im dey lead dem like sojas. E know how dem plenty rish and E dey koll all of dem by dia name! En pawa big well-well and no one among di stars dey miss.
God wey kreate heaven kon stresh am out, wey make di eart and evribody wey dey inside, di Pesin wey give life to di pipol wey dey di eart and spirit to doz wey dey waka inside sey,
Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.
God wey kreate di heavens and di eart sey, na-im still bi God! Na mi kreate di eart well and I nor kreate am to dey empty, but na for pipol to stay. E sey, “Na mi bi God and e nor get anoda one.
Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.
For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.
“Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem.
But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
E swear with di Pesin name wey go dey forever and ever. Na dis Pesin kreate di heaven, eart, sea and evritin wey dey inside dem, den di angel kon sey, “Time go soon rish!”
Di angel kon shaut: “Make una dey fear and give God glory, bikos di time wey E go judge di world, don rish. And make una woship di Pesin wey make heaven, eart, sea and where wota from dey flow!”
E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay.
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Laodicea: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di Amen; di witness wey dey obey God kommandment since E kreate di world.