Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




James 5:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 make yu know sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom back from di bad way, don save yor soul from deat and e don make Christ forgive yu all yor sins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




James 5:20
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di pesin wey God forgive en wiked ways and sins, make e happy!


Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin.


Propaty wey yu use wayo take get nor go do yu any good, but trut go save yu.


Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life, but pesin wey dey prish give odas to turn kom meet God, get sense.


Wen God won judge yu, yor money and propaty nor go fit help yu, but na to obey God bi di only tin wey go fit save yor life.


If yu wont make pipol like yu, den forgive dem if dem do yu bad. Remember sey bad tin fit skata friendship.


“I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.


so dat my pipol go dey jealous, bikos of wetin God dey do for Gentile pipol. Dis go make dem turn from sin kom meet God and E go save dem.


God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.


Wen I dey with pipol wey get weak faith, I dey live as dem dey live, so dat I go fit win dem. I dey do evritin wey I fit do, so dat I go fit win evribody wey I fit win, kom meet Christ.


Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.


Na mi Paul take my hand rite dis leta sey, I go pay back, but I fit still sey, yu yorsef dey whole mi.


Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.


So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.


Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am.


My brodas and sistas, if anybody among una waka komot from di trut and pesin bring am kom back,


As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins.


God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ