Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




James 5:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Elijah na human being like us and e pray with all en mind make rain nor fall. True-true, for three and half years, rain nor fall for dat place.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




James 5:17
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”


Afta sometaim, for di third year wey rain nor gri fall, God tell Elijah, “Make yu go meet King Ahab and I go make rain fall.”


But I tell una di trut, wimen wey dia husband don die many for Israel for Elijah time, wen God stop rain for three and half years and betta honga kon dey evriwhere.


But Pita hold am kon sey, “Stand up, bikos I bi ordinary human being like yu.”


“Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem.


God nor rijet en pipol wey E choose from di biginnin. Dem rite for God word about how Elijah beg God for Israel pipol sey,


Dis two men get di pawa to klose di sky, so dat rain nor go fall as dem dey profesai. Dem still get di pawa to turn wota to blood and to kause bad tins to happen for di eart.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ