So wetin I go do? Bikos e get time wey I go pray with my spirit and time wey I suppose pray with my mind. Sometaim, I suppose sing with my spirit and oda time, I go sing with my mind.
My friends, wen una gada to woship, una must do evritin to help one anoda. Na so e suppose bi wen somebody dey tish, sing, profesai, tok with difren-difren language or dey esplain wetin di pesin tok.
Dem kon dey sing new song for di throne, di for creatures and di eldas front. Nobody fit learn di song, escept di 144,000 pipol wey God save from dis eart.