My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.
God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.
Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!
Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.
Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.