4 Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.
“Go tell evribody for Jerusalem sey: ‘God sey, “I remember as una dey faithful wen una dey yong. Una bin love mi well-well like woman wey just marry; una follow mi waka for wildaness and for dry land.
God tell mi, “Make yu go love yor wife again, even doh e love anoda man and dey sleep with difren pipol. Na so too God love Israel pipol, even doh dem turn kon dey serve oda gods and dey give dia rice as ofrin to juju.”
“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
If una bi friend with di pipol for dis world, dem go love una as dia own pipol. But una nor bi dia friend, bikos I don choose una from di world, naim make dem nor like una.
Wi bi God enemies before, but E don make us en friends thru en Pikin deat. Naw, since wi don bi God friends, E go save us thru di life wey en pikin get.
Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?
God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.
Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.