15 Instead, yu suppose to sey, “If God wont, wi go dey alive and wi go do dis or dat tin.”
Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.
So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?
but e tell dem bye-bye kon sey, “If God wont, I go kom again kon si una.” Den e enter ship from Efesus
and I always dey pray dey ask God if E go let mi kom si una again.
Make una pray give God, so dat I go kom visit una with happiness.
If God go let mi, I nor go one branch si una for small time naw, bikos I go like kom leta, so dat I go fit spend more time with una.
But if God allow mi, I go soon kom meet una. Den I go know if pipol wey dey boast, really get pawa.
As God dey help us, na new-new tins wi go dey tish una about di faith.
But as e bi so, yu dey boast dey karry body up. All dat kind boastin nor good.