So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’
But wen di Farisee pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, “Na Belzibub (wey bi demon oga) pawa e dey use take drive demons komot from pipol body.”
and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”
I ponish dem many times for all di sinagog and I try to force dem make dem curse God. Bikos dat time, I dey vex for dem well-well, I even travel go oda towns go sofa dem, bikos of wetin dem bilive.