“Wish of di two shidren do wetin dia papa wont?” Dem ansa, “Na di first one.” Jesus kon tell dem, “I tell una true word, tax kollectors and ashawo dem go first una enter God Kingdom!
Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.
Rahab tell dem, “Make una run go di kountry for di hill, so dat who dey porshu una nor go si una and make una stay der for three days. By dat time, pipol wey dey porshu una go don kom back, den una fit go una own.”
Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town.