22 Yu nor si sey en faith and work dey togeda and na en work make en faith pafet?
Di angel kon sey, “Make yu nor do di boy anytin, nor wound am. Naw! I don know sey yu dey fear God, bikos yu even ready to kill yor only pikin for mi.”
Jesus ansa, “God wont sey make una bilive di pesin wey E send.”
For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
Wi remember di work wey una don do thru faith and as una dey bear bikos of di hope wey una get about awa Oga God Jesus Christ.
If anybody sey, “I get faith and yu get work.” I go sey, “Make yu show mi yor faith wey nor get work and I go show yu my faith thru my work.”
But anybody wey do wetin dem rite for God word, true-true, God word really dey inside am. Na dis go make us know sey wi dey inside God.