Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




James 2:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Foolish man! Yu wont make I show yu sey faith wey nor get work dey yuzles?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




James 2:20
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.


God sey, “Wetin una grand-grand papa dem sey I do wey make dem waka leave mi? Dem go woship yuzles juju and e kon make dem dey yuzles too.


Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.


So, na thru faith pesin go dey rite with God, nor bi as e obey di law rish.


But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


Bikos if anybody tink sey, en too big wen e nor bi anytin, e dey deceive ensef.


Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.


Some disobey dis kommand kon dey tok tins wey nor dey good.


Many pipol nor won do wetin God tok, instead, dem dey tok anyhow, dey deceive pipol and follow Jew pipol law wey sey, evribody must sekonsaiz.


If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin.


Na so faith bi too, if yor faith nor dey produce betta result, e go die and dey yuzles.


Body wey nor get spirit don die, na so too, faith wey nor get work, don die.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ