17 Na so faith bi too, if yor faith nor dey produce betta result, e go die and dey yuzles.
And naw wi get faith, hope and love. But di one wey big pass for di three, na love.
If I give pipol evritin wey I get kon sey make dem burn mi alive, but I nor love odas, I nor go gain anytin.
For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
Wi remember di work wey una don do thru faith and as una dey bear bikos of di hope wey una get about awa Oga God Jesus Christ.
But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.
My brodas and sistas, wetin dey good if pesin sey e get faith, but e nor dey do anytin? Dat kind faith go fit save am?
Body wey nor get spirit don die, na so too, faith wey nor get work, don die.