7 Make dat pesin nor tink sey e go receive anytin from God,
God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.
Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.
Di pesin wey dey ask, must get faith and make en mind nor shake, bikos anybody wey en mind dey shake, bi like river wey strong breeze dey blow up-and-down.
bikos e get doubol mind and e nor dey stabol for anytin wey e dey do.
Wen yu ask for sometin, yu nor receive am, bikos yu nor ask well and yu won take am do wetin yu like.