Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




James 1:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 But temptashon dey kom meet pesin wey get bad tins for mind.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




James 1:14
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.


But di Oga God si as human being wikedness don strong for di eart. Evritin wey dem dey tink for dia mind, na how to do evil tins.


Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.


David send messenjas go koll am. Dem koll di woman kom and David sleep with am. Dat time, di woman just mestrate finish, so e kon go en house back.


I neva for one day like dem rish wen I go kon dey kiss my hand dey woship dem.


If I dey like and won sleep with woman for my heart kon dey wait and hide outside en door,


Make yu dey kareful about wetin yu dey tink, bikos na wetin yu tink for yor heart, yu go do.


E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”


Israel pipol, mi wey bi una only helpa go soon distroy una.


But di tins wey dey kom out from pesin mout, dey kom from en heart and na dis tins dey make di pesin dirty.


Na all dis tins dey make pesin dirty, nor bi bikos pesin chop with en hand wey e nor wosh.”


Di Holy Spirit take Jesus go inside wildaness make devil for tempt am.


But I dey tell una naw sey, ‘Anybody wey look woman kon get di mind to sleep with am, don already kommit sin for en heart.’


Since sin pawa use di law deceive mi, I kon die.


So dis mean sey na wetin good kill mi? No! But na sin pawa wey dey inside mi, na-im kill mi; bikos e use wetin good bring deat and naw, wi dey si how sin bad and wiked rish.


Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins


But make una dey enkourage one anoda evriday, so dat non of una go get bad mind, bikos of sin.


Make nobody tok wen temptashon kom meet am sey, “God dey test mi,” bikos nor-tin fit tempt God and God ensef, nor dey tempt anybody.


Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ