Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 9:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Israel and Samaria pipol wey get pride and sturbones go know kon sey,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 9:9
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Mikaya ansa, “Yu go know di trut, wen yu go-go back of yor house go hide.”


Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.


My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.


Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.


Di leaders wey drink dey katch, dem go mash dia crown for groun.


So, una wey sturbon and nor dey do di rite tin, make una listin to mi.


Bikos I know how una sturbon rish; una neck strong like iron and una head bi like bronze.


So some pipol kon tell Judah king sey Siria sojas dey for Israel aria, den en and all en pipol kon dey fear, sotey dem bigin shake like tree wey breeze dey blow.


God don sey, “I go judge Israel pipol wey bi Jakob shidren-shidren.”


Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.


Wen I don ponish Egypt like dis, dem go know sey na mi bi God.”


But wen wetin yu tok don happen and e go happen, den dem go know sey na profet dey with dem since.”


Di king go kry well-well; di prince nor go get hope again and di pipol go dey shake, bikos dem dey fear. I go ponish una for evritin wey una do and just as una judge oda pipol, na so too I go judge una. Den una go know sey na mi bi God!”


I nor go sorry for una or show una mesi. I go ponish una for di bad tins where una don do, den una go know sey na mi bi God and na mi dey ponish una.”


Israel pipol build royal palis, but dem don forget who kreate dem. Judah pipol don build many strong town, but I go send fire go burn dia palis and di towns rish groun.”


Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ”


God sey, “Una don tok bad-bad tins against mi. But una dey ask, ‘Wetin wi tok?’


Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ