21 Manasseh pipol dey fight Efraim pipol, den dem join togeda go fight Judah pipol. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
For twenty years wey Uzzaya pikin, Jotam don dey rule for Judah, Elah pikin, Hoshea kon plan and kill King Pekah wey Remalaya born, den e take-ova as king.
Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.
Di pipol go dey waka anyhow for di land, dem nor go get hope and dem go dey hongry. So bikos of di honga and vexnashon, dem go look up kon curse dia king and God.
Siria pipol kom from di east side, while Filistia pipol kom from di west kon surround Israel pipol make dem for kill dem. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
So God nor go let any of di yong men eskape; pity for doz wey dia husband don die or doz wey nor get papa and mama again. Bikos all of dem dey wiked; dem nor know God and evritin wey dem dey tok, bad well-well. But God vexnashon nor go end and E still dey ready to ponish en pipol.
E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”
God kon tell Gideon, “Di men wey yu get too many for mi to give una viktory ova Midian pipol. Dem go tink sey na dem win by demsef and bikos of dat, dem nor go kon tank mi.