20 Dem attack dia neighbour from rite, but dem still dey hongry. Dem chop dia neighbour from left, but dem nor beleful. Dem even dey chop dia own shidren join.
Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”
God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.
Di pipol go dey waka anyhow for di land, dem nor go get hope and dem go dey hongry. So bikos of di honga and vexnashon, dem go look up kon curse dia king and God.
E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”
Even wen una chop, e nor go ever beleful una and una go still dey hongry like sey una neva chop at-all. Even doh una dey try to save money, e nor go mean anytin for di end. Una go save small, but I go gi-am to doz wey go distroy una.
Den I tell di sheep sey, “I nor go bi una shepad again. So doz wey won die, make dem die and doz wey dem go distroy, make dem distroy dem. Doz wey remain, go distroy each oda.”