Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 9:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Even with all dis ponishment from God, Israel pipol nor gri turn from sin go meet di Pesin wey go save dem. Dem nor even tink to setol with di Oga God wey dey lead heaven sojas.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 9:13
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na wen King Ahaz dey for trobol, e even disobey God pass.


Pipol wey nor know God go just dey vex and even wen E ponish dem, dem nor go sey make E sorry for dem.


Israel pipol, wetin make una still wont make dem beat una? Una wont make dem ponish una pass dis ones? Sore don already full una head and una body don rotin finish.


So, work or any betta tin nor go dey Egypt again; weda na for di leader or di ordinary pipol or di rish and di poor.


My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.


Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!


I bin dey vex for dem bikos of dia sin and long-trot, so I kon ponish and abandon dem bikos dem sturbon and dey do as dem like.


Wen dat time rish, God go bring di pesin wey dey barber hair for Eufrates side, wey bi Assyria king and e go kut di hair wey dey una face, head and body komot.


God still sey, “Just as breeze dey blow and skata dirty for evriwhere, na so too I go skata una for evriwhere for di eart. I go distroy una wey bi my pipol kon kill una shidren, bikos una nor gri stop di bad-bad tins wey una dey do.


Bikos I know wetin I plan for una; my plan na to make una prosper, nor bi to give una wahala and na to give una di kind future wey una dey hope to get.


My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.


“Man pikin, tell Israel pipol sey dia land dey dry and rain nor go fall, bikos I dey vex.


Jerusalem pipol! Una yeye life don make una dirty, even doh I try make una dey klean, una still dirty. Una nor go dey klean again until my vexnashon don fall on-top una with full force.


Yu dey ponish us just as dem rite am for Moses Law. But as Yu ponish us rish, wi still dey kommit sin and wi nor gri do wetin Yu tok.


I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”


Israel pipol sturbones dey work against dem. Even with evritin wey don happen, dem nor still gri turn from sin kom meet di Oga wey bi dia God.


Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”


“I send diziz kom meet una like di one wey happen to Egypt pipol. I kill una yong men for war kon skata una horse. I allow dead body dey smell for una kamps, but una nor still gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.


God sey, “Na mi make hongry dey una town, but una nor still gri turn kom meet mi.


I go distroy doz wey bin dey woship mi, but nor dey woship mi again. Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”


But if una turn to God from der, E go kom help una, dat na if una really turn kom meet am with all una heart and soul.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ