Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.
God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.
Wen King Ahaz wey bi Jotam pikin and Uzzaya grand-pikin dey rule for Judah, King Rezin for Siria and King Pekah wey bi Remalaya pikin for Israel, mash go Jerusalem go fight am, but dem nor fit win.
bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.