Wen una go si di shidren wey I go give una, den una go know sey na mi bi Israel God wey dey holy and una go honor my name. Una go honor mi wey bi una King. Yes! Una go respet Israel pipol God.
Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol, dem go praiz am and afta E don judge all of dem, evribody go know sey Oga God get pawa well-well.
Yu and yor pipol go attack my pipol like strong kloud wey dey pass di land. Wen di time don rish, I go send yu go skata my land, so dat dem go know who I bi and dem go si as I holy rish, bikos of di tins wey I go do thru yu.
Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.
Di rizin why I make kovenant with dem, na to give dem life and peace and dat na wetin I give dem, so dat dem go respet mi and dat time, dem really respet and fear mi.
Bikos for Zin Wildaness where di pipol for komplain against mi, yorsef komplain against my kommand wen yu suppose show how I dey holy, bikos of Meribah wota for Kadesh.”
But make I tell una who una must fear: Make una fear di Pesin wey get pawa to trow una inside hell-fire afta E don kill una. Yes, I tell una true word, na-im una must fear!
Una go bring am kom di Oga una God present, so dat en go chop from una plant, new wine, olive oil and evry first-born for una animal. Una go bring am kom meet am for di place wey E choose sey una go for honor en name, so dat una go learn to always woship di Oga una God.
Saul kut two melu to many parts kon tell some pipol make dem karry di parts go evriwhere for Israel sey, “Anybody wey nor gri follow Saul and Samuel, make e know sey na so dem go do en melu!” Den God make fear enter di pipol and dem kon go fight as one family.