Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.
One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”
Na God ensef dey lead us. En priest dey here won blow trumpet, so dat wi go kon fight una. Israel pipol, make una nor fight against una grand-grand papa God, bikos una nor go fit win.”
Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.
So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’
Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
I go kom meet and save una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una. I go must ponish una, but I go do am to korrect una. Mi, wey bi God, don tok.”
Make una nor dey sturbon to God and make una nor fear di pipol wey dey di land, bikos dem bi like bread to us. God dey with us and E don defeat di gods wey dey protet dem; so make una nor fear.”
Wen una go fight una enemies and una si dia horse and dia sojas wey strong pass una own, make una nor fear. Di Oga una God wey bring una kom out from Egypt, dey with una!