9 Na Samaria bi Israel main town and na King Pekah dey rule am. So if yu nor gri bilive or trust and put yor hope for God hand, den yu nor go fit stand and yu go really die.”
Di next day for early morning, dem mash go Tekoa Desert. Wen dem don ready to move, Jehoshafat kon stand sey: “Make una listin, una wey bi Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem! Make una trust di Oga una God and E go save una! Make una trust en profet words and una go win.”
Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.
So, as straw and dry grass dey burn for fire, na so too dia life and all di betta tins wey dem get, go dry and blow trowey, bikos dem don rijet wetin Israel God wey get pawa, tish us.
Den tell am make e nor worry or fear and make e nor let anybody disturb am, bikos King Rezin, en pipol and Pekah vexnashon nor get pawa rish di smoke wey dey kom out from two firewood.
Azaraya wey bi Hoshaaya pikin and Johanan wey Kareah born with di oda sturbon men for Jerusalem kon tell mi, “Na lie yu dey lie! Di Oga awa God nor sey make yu tell us make wi nor go Egypt.
All dis tins go happen bikos of Israel pipol sturbones and sin. Una ask sey, “Na how wi take sturbon? Na who dem go blame for Israel pipol sturbones?” Nor bi Samaria wey bi di main town! “Where di place wey dem for dey serve juju?” Na Jerusalem dem dey!
True-true, God break Israel pipol komot from di tree, bikos dem nor bilive am. But una dey where una dey, bikos una get faith. So, make una nor dey boast, instead, make una dey fear wetin God fit do.
Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.
(Di pesin wey bilive God Pikin, go know inside ensef sey, dis tin na true, but pesin wey nor bilive God, dey sey God dey lie, bikos e nor bilive wetin God tok about en Pikin).